Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Reason am
by
Derekfunds
on 24/05/2025, 14:44:10 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (2)
Wetin you talk no be lie at all, if only person go fit dey consistent or get that kind of consistence and patience to dey save for bitcoin for that long period of time, indeed the  work go surely pay off. But the problem being say, for someone wey dey struggle with finance, bills, emergencies and other wahala wey involve money, at some point, financial needs go surely arise and if care isn't taken, e go surely go touch that money, except of course say him don already keep better emergency fund and other backup funds, because if them no dey, honestly e no dey possible to fit hold till that long period without touching it. And even if na just once once you dey touch am, e go still affect am unto say the investment and accumulation no dey go smoothly again.
Bitcoin investment no be for everybody na for only those wey get discretionary income because e go dey bad say person leave to take care of his family needs come dey use de money buy bitcoin, in fact to hold the coin for long go hard the person.na person wey see food eat wet make investment and e go still bad say u dey invest why person family dey sleep for hunger .Any person wey no get discretionary income, that is money wey remain after u done take care of family needs,make the person no stress come invest in bitcoin .

You are absolutely correct, I always say this that Bitcoin investment is not for everyone but e dey important or make I just use the word necessary because if you go fit invest in Bitcoin for long term omor, in future time everywhere go stew for you but make person no go put en self for problem all in the name of trying to invest in Bitcoin, anyone who don't have today should not get himself worked up but make the person hustle hard tomorrow en go fit invest na so life be and no be everybody go make am with Bitcoin investment even some people wey be say Dem don go far for this Bitcoin investment fit no make am because we can not tell what tomorrow will bring, one musician said that tomorrow dey belle and na true, tomorrow is pregnant and we don't know what it will give birth to.