Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: How many Nigerian politician can retire back to farm?
by
Mpamaegbu
on 24/05/2025, 20:50:33 UTC
Indeed, na real lost glory agriculture be for dis awa Naija so. I remember wen we dey very influential and stand gidigbam for palmoil matter. Dat era na so we go dey see palm trees almost every corner for east so. Most of those trees dem don fall dem now and no betta plan to replant dem. We take crude oil do focus and neglected wetin give us money and fame those days. Abi na coco matta we wan yarn?

Fast forward to dis era where insecurity for d kontry don com make things worse. Even d little wey we dey plant, bandits nor go let d crops grow sef.

About the Tanzanian politician wey take ova im papa farm afta retirement, na betta decision be dat wan. I just hope say awa Nigeria politicians go fit see dat wan copy.