Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Results happen overtime not overnight, don’t be misled
by
Asiska02
on 25/05/2025, 22:03:57 UTC
You really bring better illustration of how bitcoin investment na better investment to invest into. Many misconceptions dey surround Bitcoin wella wey dey make many people dey believe say Bitcoin na get rich quick scheme and dis people wey dey share this misinformation dey do am neh to bring people come on board which e no suppose be so.

Even as bitcoin investment dey ahead of any other investment for this crypto world, you gatz to show that patient and make you have belive say wetin you invest into go give you better profit for future because people wey don invest in am for past don see the benefit and the process dey repeat himself every year, so why the fear and disbelieve say bitcoin no go rise again and you no go benefit from am later. Awareness dey necessary to raise about Bitcoin and until we all come together to create this awareness, many people no go still know how important investing in Bitcoin go bring to them.