I no say na bitcoin and anytin that is related to cryptocurrencies we dey discuss in dis local board which is d reason I bring dis topic for we to chuck mouth as bitcoin and cryptocurrencies users, bitcoin is d king of all cryptocurrencies which is true in my own observation because bitcoin has d highest population of investors and traders in d crypto space, bitcoin is d first cryptocurrency to reach $100k in d history of cryptocurrency, despite d predict some people predicted that bitcoin will not get to dis amount before it will decrease for other cryptocurrencies to take d lead, is there any cryptocurrencies that share d same price with bitcoin now? d answer is no, to show say bitcoin is d king of all cryptocurrencies. Wat is your opinion forum users.
Bitcoin can't be compared to any other cryptocurrency in all aspects, weda dem like am or not see where the price don come from and don reach now yet e still dey shake the market, no cryptocurrency fit near am, see how e don get value e surprise every body mainly for those people wey think sey Bitcoin no go fit make am, and for those of us wey no shake still believe sey we dey journey and so Bitcoin no go fit stop for half road or crash, na him make our people sey make we dey patience make we no dey hurry or do follow follow we don see am now.
The penetrate wey third party people no fit sef make Bitcoin stand well and strong, because if to sey those government people or anybody fit control Bitcoin may be e for don scatter, but we happy sey that kind thing no dey na him make Bitcoin be really king of all other cryptocurrencies.
Na start na him Bitcoin just dey one start to go up, e go shock plenty people as him price go dey go up now, Bitcoin dey strong e no dey shake at all.