I just reason say this our board na for we wey sabi yan Pidgin well-well. As I take see am, if person wan drop post wey go follow grammar style, e for better make e carry am go the general board. I believe say the people wey push make we get this board do am because dem believe say we go fit express ourselves the way we dey normally dey talk.
As for me, e no too make sense say we go dey form like say na oyinbo place we dey, when be say we suppose dey run our things for ground level. As we dey yan our kripto matter, make we try keep am for that our own level — the one wey everybody go feel, enjoy the gist, and still make us unique on the low.
Abi how una follow reason the matter?