So, this makes me wanna ask, do you feel you joined the forum at the early stage (when the rules where friendly), right time or somehow late hours (as at now).
I believe sey wetin you mean by rules being friendly be sey members nor too dey get punished for things wey dem bi dey do wey nor too jell or make sense, abi? By my own assessment, now na im even dey friendly pass b4 sef. If na b4 veteran members nor dey chill for young accounts oh for discussions and if you do like sey you too sabi, dem go begin drag u sey you nor sabi wetin u dey yarn and sey you dey mislead d community wit nonsense yarn. Some of dem fit even give u neutral tag for dat kain thing.
Members then wey dem blood dey hot don cool down now. If na b4, na one week one trouble. You go fear as members dey do hot exchange of words, accusations and allegations. Now nor be like dat.