Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: You have the power to shape your child's understanding of Bitcoin investment
by
SmartCharpa
on 29/05/2025, 22:50:17 UTC
No be lie Op this tin wey you talk na true, considering how our economy dey for now it is very important wey we go start to the teach our children Bitcoin now because we nor no where these life dey carry us dey go mainly Nigeria, because we no go like wetin we dey pass true now for our country make our children them experience am, therefore na to break that wrong thinking wey dey for our country set life hard, so make we teach them on how to get financial skills and to dey independent from secondary  so that by the time wey dem finish secondary school dem don know Bitcoin well because na that stage of dem life wey no distractions, dem dey focus and serious for their academy and na we parent they guide dem, so if we come introduce am for that stage of their life nothing bad,
You know sey most of us wey just dey know Bitcoin now, if to sey we don know am since, we nor for dey where we dey now,so the earlier the better. Since our country no get anything for our leaders of tomorrow, make we make our children the leaders of their tomorrow by ourselves and make dem take their destiny into their hands and be wealthy instead of waiting for one government jobs after graduation, that will never come.

Well, if parents do not teach their children about Bitcoin at the early age, it doesn't mean that they are waiting from the government job, many parents have their own reasons why dey no fit teach them at young age. We believe say world dey develop every day by day but that kind old life go still dey our body. No parents will feel secure when their children start to dey see money at their young age. Do you think they will like to continue with their education when they start to dey see money?

Despite that our economy dey very bad, every parent still dey carry their pikin go school and you dey reason how to teach them how to catch fish since secondary school? In my opinion, that not really make sense unless the person want to spoil his pikin with money since childhood because that can lead to some behavior, and every parent feels proud that their children dey well responsible.