Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: How many Nigerian politician can retire back to farm?
by
Stable090
on 30/05/2025, 21:30:24 UTC
Agriculture , our lost glory

The worse of it is that we hardly would have an ordinary Nigerian say this right now with the current insecurity situation in the country, saying he is leaving his job in town to retire to his farm in the village. Such person will go hungry because the farm that was suppose to provide food for you will be overrun by herders.
Insecurity Dey really disturb framers right now, I go talk say na challenges wey farmers Dey face now be that, but make I no lie you, money Dey agriculture, if you get better place wey u wan do am, money really Dey but na just challenges wey dey.

Most of this our politicians wey Dey, most of them get big farms self, but Wetin dem Dey do mostly na export dem Dey export things wey dem Dey produce for their farm, and even as we Dey complain about insecurity, na places wey Dey very secure na him dem Dey find farm, and Wetin Dey again be say, na once in a while dem Dey go check am, dem employ people wey Dey help them take care of am, and if Dey wan go, na better security Dey follow them.

Na masses wey no get anything na him bandits Dey disturb for farm, all dis rich politicians, if you see d way there farm Dey big, but some of them Dey fence all d farm, and some go make sure say even if Dey no fence all, Dey go try fence most of the farm, and all na just for security purpose. If something Dey happen, and e no touch politicians, den they no get problem with that thing be that.