Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How to improve your writing ✍️ skill
by
Mpamaegbu
on 02/06/2025, 19:54:16 UTC
• Write with clarity, avoid confusing your readers and try to put it in a simpler and understandable manner .
Dis wan so na d koko for d whole writing wit clarity thing in general, nor be for only dis forum. Another thing wey u go add to it na make persin sabi how to use punctuation marks. I dey see many people wey dey write a whole paragraph without a full stop. I mean, a paragraph wey go pass five lines but dem nor go bother with comma and full stop marks. How dem wan make persin read and understand dem at once?

Quote
• And also avoid pyramid quoting , because it can affect the neatness of your post and can also discourage users from reading your posts too.
Dis wan dey painful, especially wen we see high ranked member dey do am. I believe sey na laziness to snip things out dey make members do block quotes. Laziness to edit out. E nor too make sense. D best thing na to edit comments wey nor dey relevant for d discourse and remain d specific wans wey persin wan address and quote am.