~
I believe with the time you registered, you should know about the user known as Lauda. If you know of that user (Lauda) then you would conclude now is easier than before.
😂😂😂, Lauda!
Chai, dat name terrorise dis forum nor be small oh. Account wey we nor even sabi whether na man or woman e bi. Dem nickname am, the cat those days. At some point those Ogas wey dey drag am com dey even suggest sey na different people dey run d account because of wetin dem perceive as changes in writing styles at different times. Anyway, e good as dat account self destroyed itself. Maybe na wetin make relative peace even dey here now sef. Before, no week wey drama nor dey dey here.