Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Wrong wallet address
by
Pablo-wood
on 09/06/2025, 15:56:04 UTC
At least Dy for create one means wah person go just go there go complain then Dem go decide how much Dem go give u back collect Dem own percentage, e for better that way thato loose everything just like that,omoh e no jell at all, anyways make we see weder for the future e go clear for us.
If them get person wah we fit complain give if we make mistake for address, then e the aim of decentralization go dey forfeited. The reason wah crypto come na to give us the privilege to dey in charge of our assets, and as e be  any mistake wah we make we go carry de gobe for head.

The whole thing dey very easy, e just dey teach us how to dey extra careful when we wan move funds. The only thing we get do na to dey extra careful with the address. I no know wetin go push me to rush credit person wallet, i need calm down check the address and recheck am to make sure say the address belong to that particular blockchain first before i go come check say na the project address format e dey. Person no get lose guard for situation like this