This crypto currency world Dy more serious than one we Dy live oh, because how person go send coins to wrong wallet address then the person no fit get ham back e come be like say person no Dy bound to make mistake the thing tire me self any small mistake the sender go carry him head carry the gobe. At least Dy for create one means wah person go just go there go complain then Dem go decide how much Dem go give u back collect Dem own percentage, e for better that way thato loose everything just like that,omoh e no jell at all, anyways make we see weder for the future e go clear for us.
It is what it is man, if to say that kind thing dey possible wey dem fit complain if person send money to the wrong address Naim be day crypto don comot hand for anonymity, because that mean say some people Don get upper hand to fit dey controll transactions movement and validation which makes them a third-party and the removal of third-party na why Satoshi create bitcoin in the first place. All I can say is just try to cross check very well before you hit that send button, some times I dey check up to 2 times before I dey get confidence hit the send so I urge you to do likewise, because if you send to the wrong address na otilor be that no two ways about it.