Normally gambling no be something wey we suppose Dey do for survival, but I no go lie you, plenty people now for dis country depend on gambling for survival wey no make sense, but na unemployment wey no Dey dis country na Wetin Dey cause things like that, work no Dey, and people know say dem fit Dey get small small money from gambling.
My broda I agree with you small oh but I no go wan blame am on unemployment becos I believe say the decision wey we as adults dey take nai dey make us do some certain things for our lives. Like wetin I talk for my post about working for a betting shop back then, I dey see men even women wey hold money like say na water, dey waka come inside the shop dey stake things wey even the unemployed no fit try. People dey wey get work I mean better work wey the pay make sense dey also gamble... some of those guys wey no get work if them give them work this today or if them get better work before now, I dey tell you say some go still dey work and dey gamble too, so wetin be the cos of that one my broda🤔? Make we no blame unemployment becos no be the cos, na the choice of some of we adults, if you say you no go gamble nobody go come push you to gamble when you no want unless you say you wan do am.
Even people wey get work, most of them are underpaid, money wey dem Dey receive no Dey fit do anything again, so dem Dey look for alternative ways to get money wey dem go Dey use solve problem, so some of them Dey go into gambling, but e no really make sense, because gambling is suppose to be for fun, and you no suppose carry am as sources of income.
I go also agree with wetin you talk here but still on still na we be the cos of some of our problems. Fine the pay no reach but some go put hand for taking of loan while some go think of something else outside gambling, people dey like that wey no like to try gambling and if any of them no choose to gamble them go manage wetin them get, the only thing be say person go dey think any how especially when you get family wey children plenty and things dey to pay, me I no advise that kind person to gamble becos e go worse.
Where you say gambling suppose be for fun my broda I no really see am that way becos no gambler dey smile when him dey lose, everybody wan win and if e suppose be for fun I dey tell you say nobody for dey lose. If I dey win you dey win why I go vex? People wey dey smile even if them lose na people wey money full ground even if them lose 1m e no shake them and na only that way I go dey happy my broda nobody to see am as anything serious but as e dey both ways, losing and winning nai make nothing like fun dey inside, gambling suppose be for fun but no be when 85% of people wey play game dey lose, who wan smile say him dey lose money? Gambling na challenge and as long as you enter know say na you against the system, I believe say gambling no be for the weak and if you get anger issues no go that area.
Plenty people wey Dey believe say dem fit make money from gambling do end up being addicted to gambling, if some of them no get money to gamble at that time, you go see dem Dey sell their properties just because dem Dey find money wey dem go use gamble.
Gambling be like drinking alcohol or smoking, you go say you wan taste am before you know e don sweet you before you know again from 1 you don enter 3 to 4 na so gambling dey. Lack of control nai dey make person sell things which I no advise. And I no know for una but I believe say gambling get strong spirit wey dey control the players especially the addicted ones. Gambling dey pay at the same time e dey condemn person wey get money to be nothing.
Support PIGIN For Our Local Board...