Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Nigerian youths are no longer interested in apprenticeship.
by
Obulis
on 11/06/2025, 16:19:19 UTC
The reality be sae people are no longer interested in learning skills compared as em d many years ago. I don't know how the future of our country go later be if everybody begin to lose interest on learning skills to focus on G and Naijabet. You know sae na big problem our country go d so, and we need to save ourselves and our future from the mess that is about to befall us, so that we no go be in a situation that em get some certain things wey we wan do, we no fit find people wey go do am for us. That wan no follow

Hmm this matter I no think say na news at all at all. Cuz e dey very noticeable for almost everywhere of which the online itself they testify.
Anyway, to be more correct for this matter. Na to put am say the number of youths, even under youths(-18) wey no wan learn handwork dey higher than ever before.

Nairabet no suppose stop person from learning skill na.
A look into this matter go show cases like impatience, ignorance, disobedience, arrogance and carelessness etc of this youths.

Some of them na the major case on the topic wey I been talk about (Pretend entrepreneur online)
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5545942.msg65455893#msg65455893

Them carry online 4 head wey be say them no even gat any thing to offer except to make people click by any means (click baits) and or spend their hard earned naira for stuff wey them no dey even do.

On this our 9ja don Shatter already. Because na youths be the future!!
Just as the fall away from handwork begin na so fall away from farming happen too which actually na part of handwork in a way too.
The same youths no gree farm. All this I believe na em start waiting we dey face now! (around 80s I guess). Until now wey agriculture no even follow for handwork and the ones wey dey as handwork now many no dey reason based interest on quick fix.

To say the  effects Don befall use already but more heavier than this go fit still happen.
If you analyze, these fall away from learning handwork /farming be the major reason wey make youths engagement for electoral violence increase. As politicians dey one side dey make getting of jobs difficult for graduates(school and professional education).

Youths na the answer some how. We say na democracy we dey follow, na for youth to disengage from some things!!
This go for sure help our 9ja fit get chance to reclaim our lost glory and even more!