Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Using AI to make a post in bitcointalk is prohibited
by
Tungbulu
on 15/06/2025, 10:40:57 UTC

It's good for we to avoid using AI knowing that it's prohibited for the community.
No be today wey we don know say the use of AI dy prohibited in Bitcointalk, anybody wey say him no know about am no truly read the rules and regulations for this forum, and just as op don talk already, their are consequences if you use AI write post.
Normally writing post for this forum no hard, as long as you get small knowledge here, in my own opinion wetin they make people use AI write na because of say them too lazy to write post on their own, and too much engagement wey them get themselves in, so in other to reduce the workload them go resort to using of AI, so na act wey members of Bitcointalk really need to avoid for their own good.
To use AI no be actually bad thing, especially when you just dey ask the AI to help you clarify some kind thing, in order for you to get better understanding of that thing and then also know how to take approach the matter or know wetin to talk. Where e really bad and dey unacceptable na when you go use AI take generate post or reply and then carry that reply come Bitcointalk forum, come dey pose am to be your own work, if anybody catch you dey do this one, you don enter better gbese be that and you go fit chop better punishment.