Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Crypto No be Quick Money
by
Asiska02
on 16/06/2025, 21:12:20 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
In conclusion, Cryptocurrency na better opportunity, but it can only favour people who are serious and dedicated to it, unserious fellowor people wey wan use am as a shortcut to wealth no dey last long for crypto.

Why some people no dey last for this bitcoin investment na the mindset wey them take use meter the crypto market with. Just imagine say you come with the mindset say in few months, you go become very rich, that thing no look very absurd to person? If others wey don dey the game for long no make am quickly like this, wetin go come make you wey just come today for say you fit outsmart the market come become rich quickly.

E no dey work that way and e go better make people begin dey chance their mindset towards all this things if them was really last for the market and get to enjoy the many opportunities wey crypto dey give to people. Everything need patience and follow up gradually and if you no follow am up jejely, the repercussions dey come big.