If you’ve been watching a lot of our comedy skits lately from the likes of Sabinus, De-General, or even some influencers, then you must have seen plenty of ads for different apps and platforms to trade your Bitcoin with.
In fact, there are so many now, and one thing they all seem to say is that they are “fast and reliable.”
Me I just watch there skits and nothing more, I no Dey pay attention to all those things wey dem Dey promote, because I no trust all those skits makers, I no fit see anything wey dem Dey advertise I go come follow them, because I know say plenty things wey dem Dey promote na scam. All those ones wey Dey promote sites wey Dey buy bitcoin and gift cards, most of them are scammers, and you go see our skit makers Dey promote them.
All Wetin our skits makers Dey after na money, if Dey don receive their own money, nothing concern them if na scammer dem be or not, and some of them self na their friends get them, and na all those skits makers get some self, so I no Dey pay attention to their advertisement again.
Dey get one time wey Dey come Dey create coin, Dey come Dey promote am, dem Dey use that one cash out, our skits makers na just criminals most of them be too, make we no Dey follow them blindly, if you see anything wey dem Dey promote, make sure say you do your research first before you join.
I never sabi any naija crypto exchange, so make I just continue to Dey use d ones wey I don Dey use for years and nothing do am. Most of the youth wey go talk say Dey wan create exchange like that, most of them na scammers dem be, Dey fit start am well make Dem earn people trust, but e no Dey always end well.