Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What are the trusted Nigerian owned exchanges?
by
Mpamaegbu
on 20/06/2025, 23:50:06 UTC
The only Nigerian owned exchange way I fit recommend na Roqqu. Their p2p dey fast and their rates dey okay.
I hope nor be d same Roqqu wey I know, abi dem don change. Some years ago I get wan scary experience wey I get wit a buyer wey dey use Roqqu wallet. I send BTC to d buyer and instantly Roqqu remove am, making it look like sey I nor send am at all. D thing nearly cause big gbenge until escrow com trance d thing onchain and e confirmed sey I actually sent it. D buyer chatted Roqqu, dem confirm am. So Roqqu why you remove am? Their response be sey dem suspected a fraudulent activity on d wallet 😂. Since then, I nor dey take betta eye see dem.

Any crypto company you see that is owned by any Nigerian person, please don't trade on them until you do your findings.
Dat part of your advice wey I bold get as e bi. E nor too good. Na im dem dey call profiling or prejudice. D carefulness supposed be across any exchange wey just open newly, forget who own am. I nor dey send who get am but na trust score I dey like preview. If trust score assure me of minimal risk, I put head.