E get how this our country dey infact the world, becos the kind yama yama things wey dey happen wey no suppose to happen.
For our country e get how things don be wey be say everything na the government we go blame (I understand) butwetin I wan know na how private and careful we dey with things we do or talk and how we mistakenly lick out informations through calls for public about ourselves becos sometimes na we dey take our hands take invite kidnappers, thief people them and every bad people them, I wan know...we dey always dey careful? Like You wey dey read this post now YOU dey always dey careful say your surroundings no make sense to voice out some kind important information?
For my area I dey hear one woman just dey make one harmless call (to her oh) but wetin she dey mention with her mouth eh, she forget say no be inside house she dey and her voice no need mic for the next person to her am "I have about a million in my account and I gave sister Justina 3k for the contribution" and all that, e no make sense, the amount of money she dey mention too large and e con be say she be pastor...imagine say bad people dey around dey hear her when she dey make the call, how e for be for her?
Make I no talk too much...I wan know how private and careful we dey with calls wey we dey make for public becos e get people wey dey wey sabi shout when them dey make calls...as e be so na we Nigerians dey most times dey do wey bad things dey happen to us but na government go take the blame... Make I ask again, how private you dey with your calls and informations you dey share with the next person you dey talk with for phone especially when you dey for public place about yourself?
Support PIGIN For Our Local Board...