Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Beat Money Launderers B4 Dem Beat U
by
RealNoblee
on 23/06/2025, 18:08:25 UTC
So like this now person send me money for my account, after two days person call me say na him money or her money and you think say I go respond to that person? Especially e com be scammer? In fact, how them take get my phone number because no be the number wey dey my bank naim I dey use again so how them carry her am. This na anoda suspicion wey I go suspect them, see plenty things dey happen tru true but we suppose apply cautiousness in terms of this bank transfer of a thing.
Any person fit cook story anytime any place but the question be say how them take get your number be the question them supposed answer be that, because e no easy to get person account number and phone number together.
But anyway we suppose careful because plenty things dey happen anytime. And thank you for sharing here.


The tin I no understand be say this bank piple fit dey work with some of the scammers.
Why i talk so be say even as dem dey do those transaction or wen dem don succeed, bank piple no go give beta reason how the money use waka