Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The Battle Between USD and Nigerian Naira
by
I_Anime
on 25/06/2025, 19:55:55 UTC
Make I no lie, I no want make the naira gain against the dollar. Infact, make e dey even depreciate dey go. I no need to pretend because the way the economy bad and our leaders no dey do anything, even when them fit, e no go come reach my turn before I go start to dey look loyal.
Countless opportunities bin dey for the naira to be at par with the dollar but e come look like say we leaders dey content to adding value to another man currency than their own. This matter no suppose shock me because when you dey earn in dollars, you are regarded as person wey get money and even when you decide to spend, nah naira you go convert am to oh, but still, better change go dey.
 As e be, I no sure say the naira dey in any battle with the dollar. Better still, the dollar don win since and the naira just dey live in the shadows of wetin e used to be. Make I shock you, before, the naira bin get more value than the Ghana cedi but e no look like that anymore. Countries wey bin dey rely on the naira don wise up, put more effort in not just their economy but their currency but I wonder why Nigeria no wan wake up.

Wetting you go still consider be shey if for instance dollar come drop to $1/750 naira , shey the cost of living go come down too , because I don see scenario wey be shey dollar go drop but cost of living go dey stagnant. For this country nah we dey do ourselves even those business people their own still dey their body , most of them nah just greed dey do dem . Just imagine I went to a shop to get a new shoe the gal not even the main owner told us 75k after everything the madam come later tell us 30k when she come she was like don't be angry and stuff even the gal had to apologise too because I have already made up my mind not to buy again because it was not actually what I budgeted for , just imagine she wanted to made extra 45k . The funny thing is that those called Yahoo boys still add join wetting we dey pass through, they are the one that brought the mindset of buying things at insane price even when it doesn't worth or up to the price .