Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 6 from 3 users
Re: Newbies be careful the kind of crypto projects you promote
by
BitBakerr1
on 26/06/2025, 11:36:44 UTC
⭐ Merited by Tungbulu (3) ,Joy- maker (2) ,Wiwo (1)
WiWo na better advise you give here oo, some people dey promote something way them no even research about, as I come this forum I notice say those people way they promote 1xbet them they just dey tag tag them red tag, I say make I go into am to find out the reason na there I con no say 1xbet done dey involve for scam and people done report them well well.
But e get one day this same 1xbet still con post say they won run campaign say make people apply I see some innocent people way no know watin dey happen they apply all of them way apply e be like them give them red tag self.
So anything way person dey promote or advertise e go better say before you even apply or start to they post about am you do your research about that thing very well.

Some people done enter prison for something like this so abeg make we dey careful.