Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why a source of income is very important before investing in Bitcoin
by
Stable090
on 26/06/2025, 22:36:25 UTC
Many of the youth are really interested in investing in Bitcoin when they have done research about it and see the vision of it, and then they invest too, but due to not having enough funds, they fail to invest.
Things no really easy for dis country now, everybody just Dey hustle how dem go survive, but I no go lie you people still Dey invest in bitcoin. If you wan invest in bitcoin, no be till you get enough before you go fit invest, if you Dey wait say you wan get enough, e fit be say you no go invest be that ooo. Even if na small Dey enter, you fit Dey try commot small small Dey forget for bitcoin investment.

Wetin I like about bitcoin be say even if na small amount you get, you go fit use am buy am, no be say na only when you get big money you go fit invest.

Bitcoin is another way to get rich when the market is in good condition, but we need to have another source that you can be generating money from before you invest in bitcoin to get a better profit.
Bitcoin no be get rich quick scheme, if you want to make money from bitcoin investment, then you should be prepared to hold for long term, no be say you go Dey reason say immediately you buy bitcoin, then after few days or few hours you go don get money mad money, things no really Dey work like that.

Also if you wan invest in bitcoin, and you no get steady source of income, then when you need money, na from the bitcoin wey you Dey plan hold for long term you go Dey sell am Dey chop money small small, so you see that source of income, e Dey important.