Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Wike, Sim and RSHA members Reconcile
by
mid9tclaw02
on 28/06/2025, 08:06:33 UTC

Omo e don tey I put eye or ear for Wetin concern the state of affairs for Rivers State.
I enter market today to buy one or two na so I Dey hear market people Dey talk about Wike and Sim say Sim go soon com back. When I ask how dem know na so dem update me Oo say dem get reconciliation meeting with Mr. President dem hear am for Radio.
When I reach house I com check news channels com confirm am say this thing na true.

https://www.channelstv.com/2025/06/27/peace-has-returned-to-rivers-fubara-says-after-truce-meeting-with-tinubu-wike/

https://guardian.ng/news/no-more-acrimony-says-wike-after-tinubu-hosts-peace-meeting-with-fubara/

Governor Sim say e Dey happy cos this na Wetin Rivers State need no b all the wuruwuru as him na man of peace, him go do everything within em power to keep the peace this time.

But my people this one em reconcile, if Sim com back as seating Governor Una think say em go get power? Or e go jus be puppet Governor for Wike.

I Dey reason am say Sim Fubara don weigh em losses and em don reason am say e better make em jus Dey as Governor Dey collect em choppings than say he just leave the position kwata kwata, at all at all na em bad pass.

Make them jus do make all the political tensions reduce for Rivers State, I go like see Sim back for seat sha make this Sole Administrator Dey pack em bags.

na tru talk oh Dem don reconcile them matter don finally Dy resolve me as a Rivers man I am happy, make him come so that the state go balance since wah sim was suspended nah so every projects for the state suspend the so called sole admin never do anything so abeg make this good man come back