Nigerian government only copying the bad things wey those countries dey do and leave the good things come dey suffer us in the country. Mostly this APC government e no come to develop di country but to suffer the people making di upper class people happy. And di way dem dey deal with crypto investors in the country I no think say dem go do dat kind thing when dem dey fight against crypto currency like this. No bi say dem no get di money to do reserve but corruption no go allowed dem do am. A.d Nigerian government no go am.
Crypto as reserve no be the thing way this country way full of debt need, dem need to use money way they there hand carry do better thing way go empower the people to they productive for their self make dem really use the money way them they borrow carry am do watin them really they take am for, the only thing way dem fit do for us nah make crypto law clear make dem no they bully people way they into crypto if dem wan get reserve them fit they take from the tax way the exchange suppose they pay them carry stack up but to carry money of Watin dem suppose carry do another thing invest in crypto eh no possible unless say you wan hear say dem don go borrow money again from somewhere to make that happen.
But come to think of it. How Nigeria Wan take achieve that. Those countries wey they talk about these kind of developments na country's wey their government don mature well and wey don take deliberate efforts towards strengthening their economies. Na countries wey wan see the growth and development of their economy no be country like Nigeria wey our leaders dey in state of confusion, when for most of them, it is like they're in a state of dilemma. All wey them sabi na dem dem. None of them dey even think about me and you. Hence the reason why they're beclouded with their judgements and decisions, oftentimes making the worst decisions for the people.