My people I know say some people go don talk about panic and selling during dips and corrections but I jus wan say Wetin I don observe, cos even after the warnings/advices and knowledge Shari e still Dey happen. E jus be as bible talk am say d poor go always dwell amongst you, the poor no b only for wealth Oo, Poor mindset Dey.
Jus as our faces differ so does our minds differ, no matter the knowledge or experience people will always act different.
For this bitcoin business no b everybody wey Dey am get the right knowledge, some people na jus cut and join knowledge dem carry Dey run their parol na why e b say even when some person don old for bitcoin e go still get fear of dip.
Another na say as day Dey break more and more people Dey get into bitcoin, this newbies just Dey step into the waters for the first time, normal human nature of survival and scepticism still Dey body small despite all the good testimonies and historical evidence dem don see.
Another na say people still Dey invest into bitcoin with money wey dem wan use for something na why dem go fear dip make e no pass their point of entry.
Even as we wey Dey this forum don dey hear “use ur discretionary money, Use ur discretionary money” it still get one or two people wey go use their money for expenses take invest.
These people godey reason say e better make dem collect small gains than to lose part of their money and this na cause of say their bitcoin knowledge Dey limited.
This na some of the things I don observe why panic and fear of dip go always Dey !…