Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason why many Nigerians never invest in crypto.
by
Obari
on 01/07/2025, 08:10:26 UTC
Investing is not really a culture in Nigeria that we can say is not dominant in Nigeria. Formerly we fit dey blame say na the economy dey make many Nigerians nor fit dey consider investment as e require big money to take invest. As cryptocurrency dun show face, the opportunity to invest dey open for all, and e cun dey obvious say nor be just the economy dey worry us, but plenty other reasons.

First question na
- you be Nija person at all?
- you sure say dem no use better spoon take born you so?
- you truly Dey foot your bills by yourself?
- anybody Dey dependent on you?
- wetin be your current financial situation
- you get children?
- you Dey battle any health issues?
And many more questions Dey my head but first answer this one’s and we go under the next round of question because I see no reason wey we no go blame government for our predicaments and most times, people wey I don see wey Dey blame others rather than the government Dey gain one thing or the other from the government or Dey try to wan gain, na the country we Dey inside be that, full of selfish and hypocritical people and the Moment you choose to be tactical dem find one name give you.

At op, I no really think say, e get anybody wey don really know bitcoin and it’s core value wey no go wan invest for bitcoin but on the long run, most of us no fit because of the questions I ask above and if you don answer those questions sincerely, I still think we are the problem then peace, else come back here come redress that your talk.