Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerians in 9ja board
by
001James
on 01/07/2025, 09:36:23 UTC
Trashy post
Meanwhile drop one merit on this post let me benefit from your source merit first before anything.
Op said he don't have merit from his source merit 😆 then another dude came out to say he also distribute all his source merit..
My question be say, them done distribute merits for the local board and em still dey talk say Dem dey see enough post to merit? WTF? 😂
Mia Chloe AKA Mr Merlin abi na 4 technical board you go spend am?

Mia Chloe I won thank you big time, the reason I dey thank you na because you carry this matter come here you really try na man you be, all of us no say the way we they do with merit for this our local board no they good at all, me I no go totally blame merit source for lack of merit circulation for this our local board because everybody follow put hand to cause lack of merit follow, if merit source give you 2 merit you go get 1 sendable merit, if they give you 4 you go get 2 sendable, now those your sendable carry am send for better post way you see for our local board, no go they trade am.

Mia Chloe I go tell you the real cause of all this things na Alt account, the high level of AIt account way dey this our local board too much, person go receive merit from the local board con get sendable en go use am grow en other AIt account, na this thing be our problem, just this thing.
Those other local board way una they see say merit they follow well then no get many AIt account the way our people get, so when they get sendable them they send am to the next good post.

Now na to fine solution be the thing no be to talk about the problem, make una they bring solutions.
For me to solve this problem na for merit source to they give account to how many good post them send merit to, and merit source for our local board no go talk say good post no dey here that one na big lie for the full forum na our local board post good pass, how I take no be say when I enter other local board translator option go come out for my phone I go click am all there writing go change to English, there post no reach our own at all but there merit source they merit those posts, but our LB good post full but no merit.
And again those people way them send merit to way con get sendable merit, them go they watch una to see if una go send am to good post or una just trade am, if them find out say you trade am them go call you out, meaning we go they make list of people way they merit post way no good, way con mean say na trading you do.

This na the solution way me get.
Speaking from another person way dey post for local board but Mia Chloe never merit an before
No dey carry everything play my gee, na serious matter we dey so and e go good make we no carry our mind comot from am. You dey mock OP and me sef no like am. Make you use your headIf say you dey use your main account, you no go dey jonze like this, abi you dey fear person for this place wey make you wear mask of a newbie?. I go advise make you use your main account dey knack reply here, make all of us join hands straighten this matter, this your trolling no dey help matter at all, e dey make am worse.

If you get solution, carry your real identity bring am come table make everybody chook mouth for am. I go fit swear say you no be newbie at all.

Oga go rest... I no dey talk dis talk am e sweet you.