Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 2 users
Re: Reason why many Nigerians never invest in crypto.
by
Josefjix
on 01/07/2025, 10:33:57 UTC
⭐ Merited by Juicyhome (3) ,CryptopreneurBrainboss (2)
How you see am? and what other reasons can we point out?
Plenty Nigerians no like anything wey concern online Business, them no dey trust am at all, they come up with so many questions like, how I go invest in wetin I no dey see for eye, what if my money disappear, who I go hold, e no dey possible to hold internet responsible for your loss of money.

So Nigerians want someone to hold responsible if things so south. As Nelson4love talk about MBA forex, mmm, these founders were held responsible when things didn't go as planned, Mavrodi was sued to court when mmm crashed, same thing with the founder of MBA forex.

I think this is the reason why Satoshi go anonymous till today, because it they know him, he should've be arrested by now, so Nigeriana wan invest in wetin them dey see and know the owner house gon gon, if them no see am, them no dey put body.