This matter you drop make sense but e be like say plenty no dey really value all these kind of things, democracy day even the 1st October self people no reason am on like before when e happen you must notice am like the mood of the country go change but now nothing to show for when people dey suffer full everywhere, if no be say children no go school I no sure say people for acknowledge the fact say today na democracy day.
You get d true picture of how d matta be. Nothing much to add. Na persin wey dey happy dey celebrate. These present day politicians nor dey give us joy at all. I rememba wen I dey small as a teenager, October 1st na real celebration for my house then. We dey cook like na festive time, betta rice with chicken stew and drinks to go wit. I dey talk of in d 90s wen rice na once in a while food. Nor be now wey dat food don abused by kids.
Anyway, this day, whether May 29th or June 12th or October 1st nothing concern me again. I dey run dem through na any other day.