What gives them the right to call for peace outside their shores when they can't provide one within theirs? It's as though they prioritize peace outside than inside our country.
No, nor be sey dem príoritize peace outside pass d wan wey dey for Naija. Na just eye service and hypocrisy dey do awa politicians. Dem want make others notice dem. Wetin even concern Israel and Iran matta com concern us in d first place sef? If dem talk sey make animals wey get horns com out, snail nor supposed com out na. Wetin concern Nigeria concern world powers. Shey we fit separate two elephants wey dey fight ni, abi na wetin? We neva fit curtail small small bandits wey dey worry us na to go chook mouth for big boys gbenge.