Make i never conclude yet say na means to embezzle money again be that, Dey go talk say dem Dey train people, but at the end, we no go even see people wey dem train self, and maybe at the end, dem go talk say people wey dem train, dem give them certain amount of money to start up, but we no go see people wey dem train, and even the money wey Dey go wan give, we no go see am. I just Dey make assumption, because na small thing for our government side.
I don’t really know people wey dey advice federal government, because among different things wey Dey, d only thing wey dem fit choose to eradicate unemployment na him be forex trading, that’s really crazy. We sabi how trading Dey difficult and risky reach, and even people wey Dey advise federal government self go know, how dem go come talk say na d only way to eradicate unemployment be that. People wey dem train, most of them go run away at the end, because make I know lie, na money dem go just Dey lose.