Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Nigeria Don Finally Recognize Bitcoin as Legal Investment
by
Kelward
on 09/07/2025, 12:48:10 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (2)
I no know where you go get dis your information say "Nigeria Don Finally Recognize Bitcoin as Legal Investment". Abeg dis your information de misleading and I de skeptical about di link wey you share because I no know any legit site wey go de share fake news.

As far as I know nothing concern Nigerian government with anybody Bitcoin investment. Bitcoin de decentralized and if you hold am for your none custodial wallet na only you get di privacy and freedom over your Bitcoin. E no even de recommended for Bitcoin investors to leave dem BTC inside exchanges because if no be your keys no be your coins, any exchange fit to collapse at anything. Na only Bitcoin wey you leave for inside centralized exchange account na im government fit to trace for money laundering matters. Government fit to regulate exchanges but nothing concern dem with Bitcoin wey de for your wallet wey only you get di total custody.