Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A Bitcoin debate and discussion
by
SmartCharpa
on 09/07/2025, 17:21:48 UTC
In my opinion, you did not just argue with them anyhow, you just introduce yourself as person wey still dey learn and you drop your point so them go fit understand but you no go expect anybody to come your way. You did your best to explain give them that Bitcoin no be scam, and trading dey different. Trading dey very hard because you must need experience, plan, and strong mind. People dey always mix up crypto trading with Bitcoin sef, and na there confusion dey always start. Bitcoin don dey game for over 15 years and many big companies dey use am, that one sef no fit ever be scam.

Moreover, that advice wey the person give you say make you only invest money you can afford to lose, is one of the best investment advice wey person fit hear be that. It does not mean say dem dey fear risk, it just mean say make you no use your last hope invest for something wey fit go up or down. E good make person dey always play safe when it comes to investment. So you don't have to feel bad say dem no agree with you. You still reason well and show say you dey ready to learn, na so better mindset dey start. Just continue to dey study, dey observe, and dey learn more about Bitcoin, one day you sef go be expert wey others go dey listen to.