Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
This one na for people wey wan give up on cryptocurrency.
by
MainIbem
on 10/07/2025, 04:18:41 UTC
"Hmmm this Cryptocurrency too hard oo", dat one na  the kind talk wey you go mostly they hear from people wey never too sabi cryptocurrency, people wey think say eh too hard, wey think say dey go just start to dey do am begin they get money sharp sharp. My brother, even trading wey dem say get short-term goals still need person to dey consistent. Consistency na one thing wey you need if you wan survive for succeed for crypto, no matter the area you wan focus on, eh good make you sabi am well well then follow the due process too. For example, Person wey be Bitcoin investor suppose dey discipline, then dey patient enough to watch wetin dem dey invest on grow for the future. Person wey be trader suppose dey consistent for the market to keep up with the trends and news, eh suppose dey very strategic, know when to enter inside the market, come know when commot too. Person wey dey mine crypto suppose know the right tool whether na hardware or na software oo eh suppose know the better one to use come get better strategy too. Person wey dey farm airdrops suppose try sabi projects wey go get hope to do well, eh suppose get engaging community, dey punctual to de farm the project, then get better informations about potential projects too. All these things na different areas of cryptocurrency wey i sabi and i done try explain am for lay man understanding of how people fit succeed inside any. Cryptocurrency no too hard like people think if you understand the different areas you wan put body inside then do am well, hope dey say you go dey successful.