Guys, I been dey reason this matter lately. As our country economy no wan kukuma dey stable, we all don see how young people particularly teenagers don dey flood the yahoo-yahoo industry every day sotey, the society don they almost dey ravaged by this plaque of illegality.
I want make una help me think about this wella, how can we introduce our younger ones at home (siblings) and within our community into the financial benefits of bitcoin among other cryptocurrency at their very tender age, so that they can start creating that ripple effect of financial awareness and opportunities to their friends and family, with the intention of building a grassroot financial freedom as well as take them off the influence of peers on financial illegality?
I understand say our economy dey get worse everyday, but I no believe say to introduce young people into Bitcoin go solve the problem. If some people begin know how e sweet to dey make money from small age, you think say dem go still take school serious? This world wey we dey now, even small pikin wey never reach 15, na money matter dem dey talk every day.
And if you introduce Bitcoin to young ones wey never get money to invest, many of dem fit begin do anyhow or even steal just to get money make dem invest. Na so problem go start. No matter how hard things be, life is still about patience and time. I remember wetin my brother tell me back then when I enter university. E no gree teach me anything about Bitcoin. Him say make I focus on my education first, because if I start to dey chase money that time, I for no fit concentrate for school at all.
Life no be competition. E get time for everything, if we rush give dem Bitcoin knowledge without better understanding, we fit push dem enter big wahala, so make we no rush anybody, they should understand life small, before we introduce anything wey fit distract dem. Because at the end, na patience and good beginning go save person from bad situation.