I see am well well say OP dey yarn future tense for here and no be present tense. I never hear Oga Tinubu or em talk talk men yarn anything wey concern cryptocurrency for long time now. The latest news wey dey on ground now be say make bank dey report transactions wey pass #5 million to tax authorities. This government dey busy dey implement tax reforms everywhere for the country without any meaningful infrastructural development. Them no even get cryptocurrency time for now, but I feel say the percentage we dey pay for Exchanges like Bitget, Nigerian government get cut inside.
Capital gains tax for crypto assets dey since for the law, na we dey do stronghead no dey gree declare our crypto assets and pay taxes on am because our government stand with am no dey clear.
Even if CBN release memo give bank say make them dey do direct transaction with crypto related activities and FG give open speech for am say the country don dey very friendly with crypto. I no go transact directly with my bank because e fit still be trap to catch those wey dey into crypto and block their accounts.