But is it that the owners of the exchange e no dey aware of weti dey happened or they just keep am like that to spoil things for them? I am really tired of that nonsense. How person go invest and getting small profit and vendors go come dey price nonsense. If dem put $1540 to buy, let dem buy am with day amount and not do other way round.
Something like dis never happen to me before, but I don hear people complain about something like this before. All this vendors na crazy set of people dem be, dem Dey look for opportunity to scam people be that now, and exchange no sabi all dis things.
You even get luck say dis one Dey even bargain with you, if you Dey run transaction sometimes, some go reduce the amount wey dem suppose send give you without even informing you, if you no notice am before you release coin, that one don go be that ooo. If you wan sell like 35k some of them go send like 31k give you, na y you suppose Dey confirm the amount wey you suppose receive, and the amount wey you receive.
If you Dey run transaction, and d vendor the negotiate with you, no gree ooo, if him no go send money wey him suppose send, then make him cancel the transaction, if him send wrong amount, no release coin give am, go report am, if him see say you report am, him go send remaining balance give you, and make sure you leave negative feedback for that kin person so that other people go Dey careful.