Wetin carry me come join this forum na because of my love for Bitcoin,I don dey reason for long how I fit take sabi or gather knowledge about bitcoin until I come later discover this forum. Wetin come sweet me pass be say for this forum be say, I fit still dey earn some passive income join with my regular hustling and de same time ,dey also learn other interesting things about Bitcoin. Normally my regular hustling no be dey reach me to sort out my bills nah make I come enta crypto currency since I already get passion and interest to learn and to used my knowledge after I don sabi am used support my hustling. Omo person wey get one source of income for this country no go fit meet up especially we de way de prices of goods dey take add up for market, nah make I been come enta crypto currency to gather useful knowledge wey I go fit used take make money in the crypto ecosystem. I thank God for the Snr man wey be introduced me to this forum,now I don sabi many things about Bitcoin and I Don even dey earn small small money from this forum wey I don dey take hold my side.