Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Learn how to accept your loss as a trader.
by
Moreno233
on 11/07/2025, 21:32:07 UTC
Omo me no be fan of crypto trading sha cos that gbese don injure plenty people on lowkey. Even at that, wetin you yan na the koko be that. If u never ready to collect sometimes, e beta make you kuku avoid crypto trading base on say no matter how u shine ur eye reach, you go chop L sometimes. Money de the business but as u go fit quick make money from am, na so u fit quick lose money too, so na for u to ready to take anything wey come out unto say u know wetin de involved for the matter.