* bitcoin investment scam: This one no be Bitcoin investments and ee get some promises way them dey make way be say we self go see am say the promise too good to be true, only thier promises self fit give us assurance say the project no follow so we need to Stay away from this kind of projects.
If you don dey this crypto space for quite a long time, you suppose know when bitcoin investment scams dey showcase themselves as been the best investment platform for bitcoin. Anybody wey don sabi this forum and don learn well the right way, them suppose know say no any other investment platform for bitcoin be the best aside make you self get your own full control of your bitcoin with your non-custodial wallet and your seed phrase dey save with you without any third party getting access to am.
* short term trading: These one na very difficult game way person no supposed put body, so I no fit recommend this to anybody. Because this one no dey waste time dry person most of this speculators lose all their money quickly, trading just dey like predicting human behavior and we know how difficult it is to predict human behavior this is why we gats avoid am too.
Trading no be prediction place and anyone wey they see am like that no either get idea about am or just wan blindly trade without knowing the actual situation of it. Trading dey very controversial and no be something wey if you just come into crypto you go just wan jump into, you need to take your time to learn and become a good trader before you go begin trade.