As Nija people way we be, which people way una feel say go do well with these crypto forums way de pay in BTC, USD or other forms of payments? An office worker, way de go work early as 6:00am and return by 6:00pm in the evening, government worker way no get time of closing/resuming duties or business owners way de self employed with probably no workers attached and business owners with few workers.
Make you no see this forum earnings as your main source of income but as another source of income to take complement other ones wey you dey into while also been at your best contributing quality discussions back to the forum wey you dey earn from. The way I see this forum ba, when you don already be part of am, you no go fit even fit leave am and any condition wey your work take be, you go still create enough time to accommodate all of them and still dey benefit from both sides. This place be like a skilled work, wey be say you fit dey do am at any condition wey you find yourself later and will do it at your best still.