Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
I dey worry for the future of my countty
by
FirmWars
on 13/07/2025, 18:27:48 UTC
I fear for the future of my cointry, I don old already, I come dey think say our youths are our future, at least in tech the youths go take things further and hopeful it go help the country but I come dey sad after so many small boys for my cabal wey me dey teach bitcoin and trading are all into fraud.

The street dey raided last week and only two out of them eight boys are clean, and the ones wey I teach gangan they scam foreigners of their money, them come they collect the money with Bitcoin, dem no even know say them fit track them back o, it was like a action movie that day.

I even dey tell my sisters say I fit stand for them kids because I trust them, I was shocked when the matter escalated o, youths of our time no get patience again, them wan make money faster, dem no get chest for failure at all, I swear I try for this life, because the failures wey I don go true ehn I no suppose get anywhere again.

If every youths for country come turn criminal like this, shey this country get hope again so? No wonder the old politicians dey say the youths will destroy the country more than them if they take over. Nawaho