Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
I don’t understand where you get that kind talk say people dey predict Bitcoin price just to make others buy so the price go rise. Honestly, make you no let anybody deceive you, nobody fit truly predict wetin Bitcoin price go be tomorrow or even in the next few years. All those talk $500k and $1 million before 2028, na just too much talk. Bitcoin price dey very unpredictable, even people that sabi am no dey sure how e go move.
People wey really dey invest in Bitcoin no dey do am because of hype or quick profit, dem believe say Bitcoin get better future, and na long term gain dey focus on. Dem know say the Bitcoin price fit go up and down anytime, but dem continue to hold because of the believe wey dem get and the benefits Bitcoin fit bring. Dem no dey invest for today or next week, dem dey invest for the future.
Sometimes na traders or short term investors dey use prediction as method to make others rush enter the market. Once people don buy the price fit rise, and dem go use that opportunity sell their own and cash out better money. So make you dey very careful do your own research, and no just dey follow prediction anyhow. Invest with sense, no be waiting dem talk.