Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of saving from your salary.
by
SmartCharpa
on 14/07/2025, 07:06:51 UTC
I notice that some of our youths in d country don't no how important it is for someone to save from his or her salary to grow financially in d future. Wen u save from your salary, it give u opportunity to plan your life well by looking for potential investments to invest your money to have something to fall back to wen u lose d job. There are some youths in this our naija local board, that used their savings to buy cryptocurrency and they are doing well both in cryptocurrency and other business in d country, because dey have d knowledge of cryptocurrency to take advantage of their salary.

I brought this topic to encourage newbies and some old members that are working in some companies, to take advantage of their salaries to invest in cryptocurrency and other assets that are profitable.

You talk well OP, na true say we suppose learn how to save from our salary, because work no dey last forever. The job wey we dey do now fit end any time, either we lose am or we retire because of age. If we no use the chance wey we get now to invest, when the job no dey again, where we go start from? E go dey very hard to start again, especially when our energy no be like before.

However, na why e good make we appreciate wetin we get now and try build something from it. Life is not about competition, and we no suppose dey copy people wey dey do well because all of us no get the same source of income. If na crypto you believe in, invest small small, If na business you sabi do, use your salary take start something. Time no dey our side at all, make we make use of the chance wey we get now.