Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Scam on the rise, make your close relationships no sweep ant put for your body.
by
SatoPrincess
on 14/07/2025, 17:32:06 UTC
Omo, if this na gadget way your wallet Dey inside or you Dey carry work, then you need to draw their ear make them know the kind link way them Dey tap and not to download anything put for your gadget o. Next thing you go know be say, them don download one malware put for your gadget way go steal your privacy details, hack your gadget and collect you wella from your wallet and exchange.
Another hand no suppose touch device way your crypto dey because anything can happen. If you know say you no get cold wallet or hardware wallet and na your phone be your main storage device you suppose buy one cheap android way na only your bitcoin wallet go be the only app inside. Abeg make everybody dey security conscious as them dey hodl their coins.