Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Useful information for Nigerian newbies
by
Sexylizzy2813
on 15/07/2025, 22:51:01 UTC
Greetings all, as a newbie what is required for a newbie to do. How many post is required from a newbie daily, how can one gain merit. Is it just post about Bitcoin that gives merit.
Read the OP posted of this thread:

https://bitcointalk.org/index.php?topic=5462934.msg62680420#msg62680420

If you want to earn merit, be useful on this forum, be active and post good. It can be like hard for newbies to earn merit, but once they a newbie earn few merits, he would have understood the forum a little already and he will earn more merits.

Let your first aim on this forum be about learning and contributing useful posts.

But you know say e get plenty newbies wey don waka plenty places and them understand things for this Forum but shi shi merit dey hard to get from our area instead na international board wey them dey post dey acknowledge them dey throw them merit...you know that one?
E bad say we only dey good at advising the newbies but to appreciate the little wey them sabi to keep them here na very hard something. Charlie, e get plenty things una wey be post holders for the Forum and for our board suppose do to keep everybody here I mean with the newbies and others wey decide to avoid this place, before you know them go come back. Power wey enter una hand make una no use am against each other...our own na to look how una go handle this our board. Me I go advise if una go take am oh, make every of una wey be merit source and moderators try to do something different and special for this place, leave wetin the next person dey door talk and e go better. Make we too go outside learn from these away people and bring the knowledge and ways them dey do things for this our board and una go see how the moto wey we all enter go take us higher than how we dey now.

Support PIGIN For Our Local Board...