I no know say wi can post for pigin for here I saw one guy talk say e posibu and I dey very hapi, I saw som post say pigin gud but I go like to post for igbo, e dey posibu?
You just be like Helicopter wey no dey wan trek before e fly. As a newbie, the first thing wey you suppose do na to read the rules and regulations wey dey guide the Naija Local board for
Here before you go begin make your first post for Naija Local board. E fit be say you no too Sabi write English or Pigin but you go also understand say here na Naija Local board and no be any ethnic group get am. If you write for Ibo, how Yoruba man and Hausa man wan take read am?? Make you try manage Pigin wey every body here go understand as na the only language wey dey allowed here with English too.