Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Which one you dey do with bitcoin?
by
Stable090
on 17/07/2025, 20:05:42 UTC
So how e be for you, using bitcoin or cryptocurrency to gamble and trade, as source of alternative income, as a Nigerian bitcointalk member?

Na the two things wey I go talk say most people Dey use bitcoin and other cryptocurrencies do for dis country be that. People Dey use am gamble, even as na just few people Dey use am gamble for dis our side, because most people, na all dis our own local gambling sites na him Dey sabi, and most of them na our local currency na him Dem dey accept, also people Dey use am trade, just to earn from it, and I go talk say na this set of people plenty pass, even people wey no to get much knowledge about bitcoin go wan trade am, the third thing wey I know say people Dey use am do for here na to hold bitcoin and other cryptocurrencies, and the main purpose of that is just to the sake for interest. You go hardly hear say people Dey accept bitcoin or other cryptocurrencies as payment method for here, so I no go talk say dem Dey use am for transaction yet.