Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Which one you dey do with bitcoin?
by
Jegileman
on 17/07/2025, 20:25:54 UTC
⭐ Merited by Wiwo (1)
So how e be for you, using bitcoin or cryptocurrency to gamble and trade, as source of alternative income, as a Nigerian bitcointalk member?

Even if I go call any of this two another source of income, then e go just be only crypto trading and not gambling. Something wey be say the outcome just depend on luck no fit be my source of income and even as trading go for make you profitable if you sabi am wella, I never still see am as a reliable source of income because of the uncertainties wey dey am and obstacles to make you dey successful through am. Other things wey I dey use my bitcoin do na to invest in other physical business wey go dey fetch me small income no matter how e take be, I no dey depend on any of those two and na very wrong dependency them be if person say he wan stick to them to dey get small change through am.